Friday, 7 November 2014

See Ghana sha! Chai!

Before now, i be better critic. I sabi criticise anything football and na because things no dey really go on well naim cause am. Ok, i get the second highest degree for coaching but to God ehn, i no fit see work wey dey befitting of my standard. The recycling wey dey take place for the coaching industry don taya me.

Last time, we win the Nations Cup. Ope o! we go Confeds Cup. No lie, we no try for that competition. The weeping boys manage to score against us. You see the celebrations? E be like say dem win World Cup. No disrespect to them sha, na as e be i just talk am.

Ok, we later qualify for World Cup. We happy die! i no too happy, make i no lie and you know the funniest part? I no know why i no dey happy. How i feel no really matter sha, abi?

We reach Brazil nau, again, another weeping side, we no fit score against them. Chai! we no dey train to score teams wey dey defend? I dey ask myself the same question anytime we dey play match. Opelope say Argentina match naim be the last match, things for different o or if to say the ref allow that Dzeko goal, to God.

We win one, draw one, lose one...we sha qualify sha. All of us don dey see am say this our team no get bite at all. When we come meet France, e come show

After the World Cup, shebi we kukuma come house. We begin prepare for another Nations Cup qualifiers. Wetin happen o, Congo come here come beat us, na only draw we fit see for SA. Sudan beat us again! Chai! Football ntoin! We try win the 4th match. Dem sack our coach, rightfully so...

To be continued...

1 comment:

  1. Lemme continue here...as a comment though. Because of the gbege wey dey NFF, them gast bring Keshi back. Now, him don come back and the player wey he vow say he no go ever invite naim be the first wey him invite. He for no invite am nau, he for hear am!

    I remember when NFF first sack am, him agent say he get plenty offers round Africa. I laff. Super Eagles work na stress so who see alternative go use two hands grab am. All na lie, work no dey anywhere. In between sef, I hear say dem say Ghana wan employ am. Ghana no kuku waste time to debunk the news.

    Now, Ghana don employ coach. Guess who them employ...Avram Grant. People wey dey support Chelsea go know Avram Grant cos he don coach the team and na because of am Mourinho leave the team. Weda una like am or not, Avram Grant na foreigner and he get vast experience. I know say Ghana get experience ex-players but them know wetin the end product go be if them employ another ex-player that's why them decide to go for a foreigner.

    For us, Keshi na our best. See ehn, even if we successfully defend our trophy ehn, we need to look to the future. Na to try make we dey almost at the same level with our European counterparts. I see no reason why we no fit reach that level, true.

    Ghana don take a step forward to make their football good. Shey we dey go back or we dey go front?

    Abeg, I wan know

    ReplyDelete