Friday, 7 November 2014

My Today...

I resumed work today...and guess what?

1 comment:

  1. Wetin really happen today no dey encouraging but man dey always learn, so i learn from am. Trusting without barriers na problem, to God. I trusted and i got burned. Person wey i take to be my own person do me. Chai! E pain me die! But in the end, God dey!

    I left the office because i was feeling somehow. No be say i no tell my mainest Oga o. I tell am but e come be like say i take more than enough days off. I don already tell my spoervisor say na like dis the matter go be, say make he cover for me. Could you believe say this guy report me to Oga sha. He tell oga say i neva come work for almost one week.

    Naim them summon me sha, de, tell me say them must troway me and say na my supervisor go replace me. See me o, i don turn story teller. Naim i begin beg o. I bin no want make dem know my parole but last last, i had to tell them.

    The matter come change o! My Oga change am for my supervisor. He say weda I no dey do am well? I say why not? Naim he ask the supervisor "why did you report him?" The guy no fit talk

    As i dey write so, dem don giam 2 weeks suspension without pay. Na me come dey beg for am

    Shey you see life?

    ReplyDelete